Thursday, November 27, 2014

Must Read: My Primary 4 Teacher…. Part 2

na so we de waka inside d ministry de find dis woman office, by
1.30pm my guy joe vex tok say he don de go house say I’m get
oda tins wey he wan do dat day, like play like play joe liv me
enta car comot even afta all d beg wey I beg am, tell am say I go
buy am beer, say I go pay 4 ashawo 4 am in d nite lie lie, dat one
no enta my guy ear. I com de reason say maybe na wash wey d
woman de wash me say she de work 4 ministry of education and
by den hunger don de waya my belle lyk say na war, I see some
pple wey de sell food under one cashew tree, I go dia buy gala
and fanta take de hol belle 4d mean time, if I finish d snack I go
jus enta hous forget about teacher joyce.
20mins leta I dey my 2nd gala I don even 4get wetin kari me
enta d ministry cos many tins jus de run thru my mind like as I
go tak wicked joe bak as I’m get mind liv me hia comot. My fone
com ring, I luk d caller e com be say na mrs joyce, I pik am she
com ask me weda na me she de see unda cashew wey de chop
lyk mad man! Omo I freeze. I tell am say na me, she ask me
wetin I de do dia I tell am say e get contract wey I de find 4d
ministry bt d director don comot 4lunch, she cut fone. I cal am
bak ask am wia she dey, she say she dey veri busy say she go
cal me leta com cut call again (4my credit o) I de try cal I’m
numba mak I ask am weda mak I dey dia de wait am abi mak I go
but dis woman no gree pik my call again. As a koret guy I knw
say she fit stil dey sumwia de luk me, I kari my fone form asif I
de mak/ansa cal, comot dia, enta bus go hous….
I enta house, baff, put my music (2pac – changes), put am 4
repeat, enta sleep mode. Wen I get mysef na by 6.46pm and na
one mumu mallam wake me wit I’m cal de tok hausa, I tel am
say na wrong numba d guy stil de tok wetin I no undastand naim
I kari vex off d call, d Northerner call again I no even boda pik d
call. Why e be say na wen u de xpect impotant call na dat time
many useless cals gode enta ur fone?, my fone ring again wit
strange numba, I com de tank God say mrs joyce don finally call
(maybe wit ha 2nd line)
Caller- guy guess wetin hapun hahahaha
Me – who b dis?
Caller – I don finally Bleep ochuko hahahahhaha
Me – mtcheew emma na u?
Caller – nobe small tin o, d babe jus de ….
Me – guy abeg I de sleep cal me bak.
Naim I off fone. D next call wey enta my fone na my pastor wey
wan remind me say d praya meetin nogo hol again 2day (asif I 4
go), d next na flashin from one mumu babe. I jus d luk my fone
de pray mak dis my teacher wey don mak me fall in lov (wit ha
toto)call me. Time don nak 8pm d wicked woman neva boda call,
I kari vex comot outside go princess bar buy beer tak relax
mysef.
That day pass I no hear from mrs joyce. In d mornin I see
message for my fone from mrs joyce, she say mak I com for d
address wey she rite 4d message by 8am dat morning omo I
drop my fone 4bed run enta baffroom cos time na almost
7.30……

No comments:

Post a Comment

SNR CHUCKLES: Great Dane with lotta Ability